E get two types of drugs wey go you use comot belle: dem bi mifepristone and misoprostol. To use tablets comot belle dey work better if you take dese drugs together. But, if mifepristone no dey, misoprostol alone go work to comot belle and e still dey safe.
Make you choose if you go like learn about instructions on how to use mifepristone and misoprostol or only misoprostol take comot belle wey dey safe.
Before you go start, make you read our advice wey dey Before You Go Use Di Tablets. Make sure say:
To comot belle wit mifepristone and misoprostol, you go need to take one 200mg tablet of mifepristone and four to eight 200mcg tablets of misoprostol. You go also need drugs wey dey reduce pain for hand, like ibuprofen, to help manage di pain. Acetaminophen and paracetamol no dey work for pain during abortion so dey no dey recommend am.
Here na how you go take mifepristone and misoprostol togeda to comot belle:
Make you take water take swallow one 200mg tablet of mifepristone.
Make you wait for 24 reach 48 hours.
Put 4 tablets of misoprostol (200 mcg for each) under your tongue and hold am for 30 minutes make e dissolve. Make you no talk or eat anything for dese 30minutes, so e good make you dey somewia wey dey quiet wia dey no fit disturb you. Afta 30 minutes don pass, make you drink some water take swallow evritin wey remain for your mouth. This na better time to take drugs wey dey reduce pain like ibuprofen, bicus you go soon start to dey feel pain for your belle.
You suppose start to dey bleed and feel pain for your belle witin 3 hours wey you don take di 4 misoprostol tablets.
Afta e don reach 24 hours wey you don take di 4 misoprostol tablets, if you no start to dey bleed, or if you no dey sure say di abortion don work, make you put more 4 misoprostol tablets under your tongue. Hold am there for 30 minutes make e dissolve. Afta 30 minutes don pass, make you drink some water take swallow evritin wey remain for your mouth.
Make you learn wetin you go expect afta taking mifepristone and misoprostol for here.
If you dey feel serious pain for your belle, ibuprofen na good drug to cope wit di pain. You fit buy ibuprofen wey get 200 mg strength for pharmacy (e no need make doctor write am) for some countries. Make you take 3 to 4 tablets (200 mg for each one) evri 6 to 8 hours. If you need sometin extra wey go reduce pain, you fit also use 2 tablets of Tylenol (325 mg) evri 6 to 8 hours.
If you dey worried about di way wey di abortion dey go and you go like anoda support, you fit call our friends at www.safe2choose.org, www.womenhelp.org or www.womenonweb.org.
If you don use abortion tablets mifepristone and misoprostol , you fit no need to go to hospital for follow up visit. Dese drugs dey work very well na im make di World Health Organization advise say you go only need a follow-up only if:
Before you go start, make you read our advice wey dey Before You Go Use Di Tablets. Make sure say:
If mifepristone no dey for wia you dey live, you fit use only misoprostol to comot belle.
To use only misoprostol take comot belle, you go need to take twelve 200mcg tablets of misoprostol. You go also need drugs wey dey reduce pain for hand, like ibuprofen, to help manage di pain. Acetaminophen and paracetamol no dey work for pain during abortion so dey no dey recommend am.
Here na how to use only misoprostol take comot belle:
Put 4 tablets of misoprostol (200 mcg for each) under your tongue and hold am for 30 minutes make e dissolve. Make you no talk or eat anything for dese 30minutes, so e good make you dey somewia wey dey quiet wia dey no fit disturb you. Afta 30 minutes don pass, make you drink some water take swallow evritin wey remain for your mouth. This na better time to take drugs wey dey reduce pain like ibuprofen, bicus you go soon start to dey feel pain for your belle.
Make you wait for 3 hours
Put anoda 4 tablets of misoprostol (200mcg) under your tongue and hold am dia for 30 minutes untill dey dissolve
Make you wait for anoda 3 hours.
Put anoda 4 tablets of misoprostol (200mcg) under your tongue and hold am dia for 30 minutes untill dey dissolve.
You suppose start to dey bleed and feel pain for your belle when you dey take di tablets. Make sure say you take di whole 12 tablets even if you don start to dey bleed befor you don take all of them.
Make you learn wetin you go expect afta you don take misoprostol for here.
If you dey feel serious pain for your belle, ibuprofen na good drug to cope wit di pain. You fit buy ibuprofen wey get 200 mg strength for pharmacy (e no need make doctor write am) for some countries. Make you take 3 to 4 tablets (200 mg for each one) evri 6 to 8 hours. If you need sometin extra wey go reduce pain, you fit also use 2 tablets of Tylenol (325 mg) evri 6 to 8 hours.
If you dey worried about di way wey di abortion dey go and you go like anoda support, you fit call our friends at www.safe2choose.org, www.womenhelp.org or www.womenonweb.org.
If you don use misoprostol, you fit no need to go to hospital for follow up. Dese drugs dey work very well na im make di World Health Organization advise say you go only need a follow-up only if:
Dis website fit need cookies wey you no go know di name and so many third party service dem to make am work well. You fit read our Terms and Conditions and Privacy Rules . As you dey continue to dey use dis site you dey gree make we do dis.